Trump AI image as Pope: Catholic conference criticise Trump afta posting AI image of imself as Pope

Trump AI image as Pope: Catholic conference criticise Trump afta posting AI image of imself as Pope


Di image feature Trump wear a white cassock and pointed mitre, wey bishops dey normally wear.

Wia dis foto come from, X/White House

  • Author, Max Matza
  • Role, BBC News

US President Donald Trump don dey face yab from Catholics afta e post AI picture of am as di Pope.

Di picture wey di official White House social media accounts bin share dey come as Catholics dey mourn di death of Pope Francis wey die for 21 April, and as dem dey readi to choose di next pope.

Di New York State Catholic Conference accuse Trump say e dey mock di faith. Di post dey come days afta Trump joke give tori pipo say e go like be Pope.

Trump no go be first president wey dem go accuse say e dey mock di Catholic faith. Former US President, Joe Biden vex plenti pipo one year ago, wen e do sign of di cross for one pro-abortion access rally for Tampa, Florida.

Vatican tok-tok pesin Matteo Bruni no gree ansa questions about di Trump post for briefing wit tori pipo on Saturday. Di Vatican dey prepare to host conclave to pick who go enta set afta Francis and e go start on Wednesday.

Di image wey Trump bin post on Friday night show am dey wear white cassock and pointed mitre wey traditionally be wetin bishop go wear. E come wear very big cross for neck and carry im finger up, wit solemn face.

Di New York State Catholic Conference wey represent bishops from New York enta X to vex for di picture.

Di group write say, “nothing clever or funny dey dis image, Oga President.

“We just bury our beloved Pope Francis and id cardinals dey prepare to enta solemn conclave to elect new successor of St Peter. No mock us.”

Wetin we call dis Video, Watch: Trump joke say e go “like to be Pope”

Left-leaning Italian former Prime Minister Matteo Renzi bin also blast Trump post.

Renzi use Italian blast am for X say, “dis na image wey offend believers, insult institutions and show say di leader of di right wing world enjoy to dey clown around.”

But White House no gree for any suggestion say di Republican president dey carry di papacy joke o.

Press secretary Karoline Leavitt tok say, “President Trump go Italy to pay im respects to Pope Francis and attend im burial. And e be ogbonge champion for Catholics and religious liberty”.



Source link